Reopening of schools in Lagos [When is school resuming in Lagos after the protest?] See update

Reopening of schools in Lagos [When is school resuming in Lagos after the protest]

Reopening of schools in Lagos [When is school resuming in Lagos after the protest]

Remember say na on 19 October, 2020 in di heat of di #EndSARS protest na im Lagos State Government direct all pupils/students inside public and private schools to stay at home following di tension wey di #EndSARS protests don cause.

Authorities for Lagos State, south west of Nigeria don announce say public and private fit reopen from Monday 2 November, 2020.

Boarders alias students wey dey stay for boarding house for public schools dey expected to resume on Sunday, 1st of November.

Goment bin close schools for di state because of di violence from di End SARS protests against police brutality wey turn bloody for Nigeria commercial city.

Lagos State Commissioner for Education, Folasade Adefisayo say dis year really tie wrapper wella wit all di wahala e cari for bodi alais unprecedented year wey lead to frequent closing of schools wit di way e dey always scata learning for all children.

Reopening of schools in Lagos [When is school resuming in Lagos after the protest]

“We pray and hope say no more thing go scata di academic calendar. However, di Lagos State Government go always regard di safety of pupils/students, parents and all staff as a matter of priority.” Adefisayo yan.

Remember say na on 19 October, 2020 in di heat of di #EndSARS protest na im Lagos State Government direct all pupils/students inside public and private schools to stay at home following di tension wey di #EndSARS protests don cause.

Commissioner for Education, Mrs Folasade Adefisayo, wey issue di orde, say di safety of di pupils/students, parents and all staff working in schools dey important “at dis critical period.”

Madam Adefisayo tell BBC Pidgin say na wen dem see say tins don return to normal na im dem go fit reopen schools.

” Lagos curfew update”

Di curfew inside Lagos State don change and from Monday 26 October movement restriction time now na 8pm to 6am.

Similar Posts:

Author: Admin Boss

Leave a Reply

Your email address will not be published.